Get Latest Tori News Alert!
Enter your email below.

Delivered by FeedBurner





Hot Stories
Recent Stories

Sapele Pastor Impregnates Married Woman That He Wedded In His Church (Photo)

Posted by Thandiubani on Wed 02nd Feb, 2022 - tori.ng

A man of God in Delta state has landed himself in serious matter after impregnating a married woman.

 
A man of God, Pastor Michael Onoyume has found himself in a mess after he reportedly impregnated a married church member.
 
The incident happened in Delta state.
 
Sapele Matters reported the story and wrote:
 
FE-GBWA-RY!!!!!
 
01/fegbwary/2022
 
PASTOR MICHAEL ONOYUME DON DOKE HE OLD BABE COMMOT FROM MARRIAGE AND LATER GIVE HER BELLE.
 
Matter wey sway enta studio since morning, indicate say Prophet Michael of Christ Church of The Light, Abiye Parish wey be Garment Church wey dey for Akintola Road near White City Hotel, nai go doke one girl wey dem dey call Onome Mebiro commot from Marriage and give her belle now.
 
Before now, this Onome Mebiro nai the Prophet dey doke steady alongside other league of girls for he church, in other words, the Onome na the Pastor Babe. But Dec 11th 2018, nai the Onome Mebiro con marry one guy, and na this same Pastor nai wed the two of dem for he church. Not knowing say the marriage na just formalities and the Pastor still dey carry out he gbenshing business with Onome.
 
Kata-kata con dey the marriage along the line as Onome con dey find excuse say he husband wey he marry na Lazy man, say the husband dey carry her money dey go groove for outside. She begin insult the man say make the man go look for work. All this wahala wey Onome dey make so, all na the handwork of the Prophet to make sure say he grumble the marriage so that he go solely dey flog Onome Mebiro Kpekus to he selfish satisfaction.
 
Last Last the Marriage con scatter and since 2020, nai this Pastor dey gbesh Onome Mebiro steady for her house for Amukpe side. We all know say this Prophet don marry and dem do the Marriage big for Sapele Athletic Club last year abi last two years sef, but he nor give this Onome Mebiro chance. Now, he don doke Onome get belle. Onome dey sell pepper and tomatoes for Sapele Market and the belle don dey show Tue-Tue like Robbison Tue-Tue.
 
All Hail Arch-doker Michael Onoyume!!!!



Top Stories
Popular Stories


Stories from this Category
Recent Stories